07/07/2026
*HAND MIXING vs MIXER: Which one better for your building?* 👇
See the 2 pictures well.
*Na MIXER dem dey use for right:*
✅ E dey FAST. Wetin 10 men go take 1 hour do, mixer go finish am in 20mins
✅ The cement, sand and granite go MIX UNIFORM. Every bucket get same strength
✅ Water control dey accurate. No excess, no shortage. Concrete go strong well
✅ Less wahala, less stress. Workers no go tire quick
*Na HAND dem dey use for left:*
❌ E dey SLOW. Men go tire before work finish
❌ Mix no dey uniform. This place strong, that place weak
❌ Water control na problem. Tomorrow you go dey complain say crack dey everywhere
❌ Cement and money go waste anyhow
*My Engineer Advice:*
If na blinding or small patching, hand mixing dey ok.
But if na COLUMN, BEAM, SLAB, FOUNDATION... Abeg use MIXER o.
No let "make we save money" turn to "make we repair house" after 5 years 🙏
Build once, build well.
You dey build now? Which one your site dey use? Drop comment below 👇